July 27, 2024
All your news, One Platform!
0803 333 3333
info@inewszone.com
Search
Generic filters

Pidgin: Ex Man United star player wey turn plumber at the age of 27 don carry advice come for upcoming footballers.

June 14, 2023

 

 

 

Ex Man United star player wey turn plumber at the age of 27 don carry advice come for upcoming footballers.

Oga Lee Roche na former Man United star although e play only five matches for Man United e even play Champions league game for Man United against Deportivo La Coruna wey Man United chop 2-0.

Oga Lee Roche say if person tell am say e go dey carry pipe up and down for site e no go believe am but thank God say e learn plumbing work as e dey play ball if not e for dey street dey beg for money.

Lee Roche join Wrexham on loan from United but injury no allow am play anything naso Wrexham use vex waybill back to Man United say dem ask Man United for Roche Man United give dem Rochas Okorocha.

Man United later pursue am, oga Roche join Burnley injury still no allow am play ball naso Burnley release am, oga Rochas say make e join Wrexham again but injury still no allow am play ball e later join one club wey no get surname in 2007 na from there e retire come dey stay for house.

PFA( Professional Footballer’s Association) come gather money give am make e go start e plumbing business because e don get the experience already now oga Lee Roche na certified plumber e no get any pipe wey oga Lee no fit fix now.

Oga Lee Roche don tell upcoming footballer say as Dem dey play ball make dem find one work dey learn because football fit disappoint dem at anything, even person wey dey 49 years still dey play academy for some countries and e no get hand work.

My people abeg wenti oga Rochas talk e good?
Abeg Incase you need e service abeg patronize this Man United legend no carry e money go outside.

 

Source: Football Pidgin

Share to:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

© Copyright 2021 inewszone Media
cross-circle